PAY ATTENTION: Follow us on Instagram - get the most important news directly in your favourite app!
Nollywood actress Caroline Danjuma, wey dem know as Carolyna Hutchings, don talk say she go like make she and her ex-husband Musa Danjuma reunite.
Remember say Caroline and her ex-husband bin end their nine-year marriage for 2016.
But for one recent interview with media person Innih Emah, Caroline talk say she go like return back to her ex-husband.
She talk say if she bin get the experience wey she get now, she no go comot for her marriage.
The 35-year-old talk say she comot for the marriage because of some “irreconcilable differences.”
PAY ATTENTION: Join Fox Nigeria Telegram channel! Never miss important updates!
She talk say, “Na just some differences wey no fit reconcile, if I been get the experience wey I get now and I been dey this age, I think say I for fit handle am better.
“He [Musa] go always be the love of my life. Na him be the papa of my three pikin. Na him I talk say, you know wetin? This man worth to be my husband. So, yes, he go always be the love of my life and e no go change.
“I go like marry again, whether na my ex-husband or one new amazing man wey God send, I go like get family. Yes, I go like go back to am [my ex-husband] or if God talk say, na this man you go marry. I just want peace of mind and happiness. As I dey old, I just want person wey I fit build with and person wey go give me peace of mind. Peace of mind dey more valuable pass money.”
What do you think about us writing Entertainment news in Pidgin? Should we stop or continue it? Please leave a comment below. We are here to serve you better, your wish is our command.